Pidgin Friday : We Carry Mat Come ooo

Wahala dey oooo
Na quarrel ?
Wetin we do now ?
Dis is a strong something ooo



Chai !!!
Abi Naija do us juju nii
See as our superstars dey fall yakata for ground
See big man like Soudani for pain


Though we hear say na fine playa
We don watch am for YouTube
We don view him fine picture
But the juju no even allow us know Ounas from Adam

Ahmed Musa na our Aboki
He tell us the place fine(Uyo)
He talk say dem set die(Girls)
Who no like faaji


We no want una Acid(water)
We go manage mat biko
Una pillow get Aba foam joor
Who spoon help sef

Ewo oooo
See fine chicks
Dem no dey hide am ?
Walahi,I go comeback

Abeg wake me
Abi I dey sleep ?
Oga driver ooooo(Pilot)
Why you con drop us for Dubai

Helep ooo
See basket ooo(Uyo Stadium)
Dem wan chop us abi
Para ! Para !! Paradise !!!


Post a Comment

أحدث أقدم