
Katsina sweat against People's Elephant but dem secure 2-1 over Enyimba and same drama give 3sc total points against Tornadoes while Wikki wicked Gombe with 3-1.
Rivers United slap Abia warriors with one goal as same thing happen between ABS wey kpopo Nasarawa United for Ilorin as Sunshine Stars shine pass Remo in Akure.
MFM fire 3-goals pass El-Kanemi in a game wey Stephen Odey score him Number 14 goal of the Season while Lobi versus FC Ifeanyi Ubah no produce any goal.
Matchday 18 Results
Katsina 2-1 Enyimba
Wikki 3-1 Gombe
Rivers 1-0 Abia Warriors
ABS 1-0 Nasarawa
MFM 3-0 El-Kanemi
Pillars 0-1 Akwa
3SC 2-1 Tornadoes
Lobi 0-0 FCIU
Sunshine 1-0 Remo
MFM dey fly for top of the table followed by plateau wey get one game for Hand. Seven and Eight na Enyimba and Ifeanyi Ubah while Kano Pillars dey number elemu. Wikki, Sunshine, Remo and Rangers dey sing for Relegation.
Photo Credit : npfl.ng
0 Comments