Stephen Odey Catapult MFM Enter NPFL Mountain, 3SC made Godwin Aguda Pay for Missing Penarity

NPFL top scorer Stephen Odey don receive another anointing from heaven when he score brace to power and thunder MFM to top of the NPFL table after dem panel beat Rivers United 2-1 for Agege stadium on Wednesday for one of the rescheduled games because of some Clubs wey dey campaign for Caf Competitions.

Stephen Odey score the first penarity early in the game to put his team ahead before Rivers United use water carry the equaliser inside the net through Christian Weli on 38th minute but Odey come reply shaperly with another penarity before first half finish as MFM lock door for the game to finish 2-1.

Stephen Odey don score 12goals while MFM join El-Kanemi and Kano Pillars as the only teams wey don win all their home games this season.

Late drama na hin happen for Oluyole town in Ibadan as Sooting Stars beat Enugu Rangers by last minute goal from Bode Daniel to punish Godwin Aguda wey troway penarity for 89th minute.

The win don power MFM enter table top while Shooting star comot from relegation to 13th position while Rivers dey contest Swimming with Rangers for Relegation pool.

Photo Credit : npfl.ng

Post a Comment

Previous Post Next Post