NPFL na the main focus after International break don fade comot for our mind after two weeks of disturbances.
Matchday sweet 16 take center stage as Plateau United waka enter Rivers like the Israelites waka inside red-sea without injury as dem play orange orange for Port Harcourt just like Remo carry ginger enter Rangers even when Daniel Etor score like Eto'o for 14th minute but Ekene Awazie do solo run for 51st minute to pick one point for the Shagamu side.
The Soup wey sweet na money kill na hin be the story of FC Ifeanyi Ubah as the NPFL topscorer last season Coconut dem to Victory over Niger Tornadoes just as 3sc manage beat El-Kanemi eventhough El-Kanemi Goalie George Michael stop Faleye Penarity but he no fit prevent Merenini Juniors from scoring the winner early for second half while Wikki wicked Enyimba wey be tenant for Calabar one kondo from Victor Alegbe 85minute coconut header off a corner kick.
Stephen Odey score him Number 13 goal of the season before Sikiru Olatunbosun thunder a Free kick to help MFM overcome Abia Warriors eventhough the away team shakara the anointed people with goal by Sunday Adetunji as Sun bright for Akure when Thomas Adesina and Sunday Oluwadamilare score for second half to package three points for Sunshine Stars against Katsina while former Kano pillars striker Adamu Hassan score equaliser for Nasarawa against Sai Masu Gida in Kano to cancel Mubarak Said 9th minute goal and na same case for Ilorin when Chigozirim Metu called police but Oladapo red card no prevent Gombe from losing the case as Mannir Ubale tie the match with 54th minute equaliser.
Lobi Stars go face Akwa United tomorrow.
Matchday 16 Results
Rangers 1-1 Remo
Wikki 1-0 Enyimba
Rivers 0-0 Plateau
ABS 1-1 Gombe
MFM 2-1 Abia Warriors
Pillars 1-1 Nasarawa
3SC 1-0 El-Kanemi
FCIU 1-0 Tornadoes
Sunshine 2-0 Katsina
Mfm don top the table again with 30point as Plateau United and El-kanemi dey follow bumper to bumper while FC Ifeanyi Ubah dey ball for number ten.
Rivers dey united with Rangers as Continental clubs in Relegation gbege.
Photo Credit : npfl.ng

إرسال تعليق