Na quarrel ?
Wetin we do now ?
Dis is a strong something ooo

Chai !!!
Abi Naija do us juju nii
See as our superstars dey fall yakata for ground
See big man like Soudani for pain

Though we hear say na fine playa
We don watch am for YouTube
We don view him fine picture
But the juju no even allow us know Ounas from Adam

Ahmed Musa na our Aboki
He tell us the place fine(Uyo)
He talk say dem set die(Girls)
Who no like faaji

We no want una Acid(water)
We go manage mat biko
Una pillow get Aba foam joor
Who spoon help sef
Ewo oooo
See fine chicks
Dem no dey hide am ?
Walahi,I go comeback
Abeg wake me
Abi I dey sleep ?
Oga driver ooooo(Pilot)
Why you con drop us for Dubai
Helep ooo
See basket ooo(Uyo Stadium)
Dem wan chop us abi
Para ! Para !! Paradise !!!
0 Comments